Although di host go still be Ebuka Obi-Uchendu but some kain tins like di winner prize money and odas sake of di coronavirus pandemic go dey different dis time around.
Wetin be di new rules sake of Covid19 wey make dis year show different from odas
Sake of di coroavirus pandemic wey dey affect kontries all ova di world, di organizers of di show don promise to obey and follow global best practices, precautions and preventive measures throughout di show. Dis na some of di changes wey viewers go see;
- Dem no go allow guests to enta di BBNaija house or get physical contact wit housemates and di number of "ninjas" go also reduce
- Di organizers say dem don cancel all audiences for live shows and evictions and di presenter go host di Sunday Live Eviction Shows for empty studio, crossing live into di Big Brother House.
- Dia must be compulsory daily temperature checks for all production crew and guests to wey wan come di House.
- Regular cleaning and disinfection of di House and production facilities especially surfaces/objects wey pipo dey use always
- Psychologists and Medical Doctor go dey on standby to support housemates and crew
Oda changes wey make dis year edition of BBNaija different?
So many tins na im change for dis year edition of BBNaija starting from di audition wey dem do online only through Africa Magic website and di grand prize plus odas
Di winner of BBNaija season 5 go walk away with di biggest prize ever, value at N85 million. Di breakdown of di grand prize for BBNaija season five include:
End of Twitter post, 1
Meanwhile before di tier rubber of di show on Sunday, di organizers don test all di shortlisted Housemates and put dem for quarantine for 14 days, and and afta dey don clear all of dem, dey come permit di housemates to enta di house.
via: BBC PIDGIN


Post a Comment